Skip to content

Authority Stealing (Part 1 & 2)

Popularity ยท Low

YouTube

Searching YouTube...

Lyrics

Eni, eji, eta, Erin... Instrumental... You be thief (I no be thief) You be rogue (I no be rogue) You dey steal (I no dey steal) You be robber (I no be robber) You be armed robber (No be armed robber) (2ce) I no be thief (You be thief) I no be rogue (You be rogue) I no dey steal (You dey steal) I no be robber (You be robber) I no be armed robber (You be armed robber) (2ce) Argument, argument! Argument, argument, argue (2ce) Them argue (Argument, argument, argue) Everbody dem argue (Argument, argument, argue) Them dem dem argue (Argument, argument, argue) Up and down them argue Everbody dem argue Them dem dem dem argue (Argument, argument, argue) Yes yes, them argue (Argument, argument, argue) Everbody dem argue (Argument, argument, argue) Argument about stealing Somebody don take something Wey belong to another person. Then you go hear: You be thief (I no be thief) You be thief (I no be thief) You be rogue (I no be rogue) You dey steal (I no dey steal) You be robber (I no be robber) You be armed robber (No be armed robber) (2ce) Argument, argument! Argument, argument, argue Them argue (Argument, argument, argue) Everbody dem argue Them dem dem argue Up and down them argue (Argument, argument, argue) Everbody dem argue (Argument, argument, argue) Them dem dem dem argue (Argument, argument, argue) Yes yes, them argue Huh Argument about stealing Somebody don take something Wey belong to another person. On top of the road, on the side People dey waka Office workers, labourer workers, workers' workers Them go dey waka Inside bus them go dey Motorcycle them dey ride Plenty, plenty crowd Inside this crowd Sometimes for one corner Sometimes for one street You go dey hear: ha ha! Catch am catch am Thief, thief, thief! Catch am catch am Rogue, rogue, rogue! Catch am catch am Robber, robber! Catch am, catch am! Thief, thief, thief! (Hold am, grab am) Catch am, catch am! Rogue, rogue, rogue! (Hold am, grab am) Catch am, catch am! Robber, robber! Catch am, Catch am, catch am! Thief, thief, thief! (Ole) Catch am, catch am! Thief, thief, thief! Catch am, catch am! Robber, Robber. Catch am, catch am! Robber, robber! Looking go start Watching go start Chasing go start Somebody go dey Wey them go grab Them go beat am well-well Them fit lynch am well-well Police go come well-well Them go carry am go court Them go put am for jail Them fit put am six months (Them go put am for one year) Them fit put am two years (Them go put am for five years) Them fit put am seven years (Them go put am for ten years) If not them go shoot am well Them go shoot am for armed robbery On top of the road, on the side People dey waka Office workers, labourer workers, workers' workers Them go dey try To try to make ends meet Them go dey hustle To try to make ends meet Them go put hands for back To try to make ends meet Them go dey beg oga To try to make ends meet Them go be slaves for them town To try to make ends meet Oh yes them go dey try to try to make ends meet Dem go dey hustle to try to make ends meet I say turn your face small All to the right wing Oga patapata dey for there Authority people dey for there Instead of workers We have officials Instead of buses Them dey ride motor-car Instead of motorcycle Na helicopter Instead of them waka Na worker go waka for them Authority people them go dey steal Public contribute plenty money Na authority people dey steal Authority man no dey pickpocket Na petty cash him go dey pick Armed robber him need gun Authority man him need pen Authority man in charge of money Him no need gun, him need pen Pen got power gun no get If gun steal eighty thousand naira Pen go steal two billion naira You no go hear Dem shout Thief, thief thief! You no go hear Dem shout at all Rogue, rogue, rogue! You no go hear say Robber, robber! You no go hear them say response at all Thief thief thief! You no go hear Dem shout Rogue, rogue, rogue You no go hear Dem say the word Robber Robber (2ce) Na different way be them way Na civilize style be them styl Yes, yes, yes, yes! "Oh yes, of course, contract, have some money back in hand, ha ha" Hear the words them dey take deceive the people: Misappropriation Yes, yes, yes, yes! Maladministration Yes, yes, yes, yes! Nepotism Yes, yes, yes, yes! Mitigation Yes, yes, yes, yes! Make I remember another one wey them dey use. Yes, yes, yes, yes! Defraudment Yes, yes, yes, yes! Forgerylization Yes, yes, yes, yes! Embezzlement Yes, yes, yes, yes! Vilification Yes, yes, yes, yes! Mismanagement Yes, yes, yes, yes! Public inquiry Yes, yes, yes, yes! Authority stealing pass armed robbery We Africans we must do something about this nonsense Yes, yes, yes, yes, yes We say we must do something about this nonsense Yes, yes, yes, yes, yes I repeat, we Africans we must do something about this nonsense Because now authority stealing pass armed robbery Authority man him go dey steal Public contribute plenty money Na authority people dey steal Authority man no dey pickpocket Na petty cash him go dey pick Armed robber him need gun Authority man him need pen Authority man in charge of money Him no need gun, him need pen Pen got power gun no get If gun steal eighty thousand naira Pen go steal two billion naira. You know go hear dem shout Thief, Thief, Thief, (Yes, yes, yes, yes) You know go hear dem shout Rogue, Rogue, Rogue (Yes, yes, yes, yes) Oh no no no you no go hear Dem shout thief, thief, thief (Yes, yes, yes, yes) Ahhaa authority stealing pass arm robbery (Yes, yes, yes, yes) We must do something about this nonsense (Yes, yes, yes, yes) Ahhaa rumu rumu rumu rumu (Yes, yes, yes, yes) End.