Lost Soul
RaptureSBO
Popularity ยท Low
Listen
YouTube
0:00 / 0:00
Loading YouTube player...
Lyrics offset
Synced
Lyrics
(Wickedest)
Started music alone nobody support my talent
Everyday i call on God it's like God don put me for silent
Carry sand and block for 7days to buy new phone
Time to sleep we no use foam
The thing pain me enter my bone
But weitin man go do?
Came back home around to 2
I lost my gee kojo rest in peace to gogo too
Ahhh! Mumsi no get money and papa sef e no dey
But she make sure food dey even school fees na she pay
Everyday overthinking
I dey smoke and I've been drinking
I dey rap and I've been singing
But when i move I'll be sinking
Make money time is ticking
Get update and I'll be pinging
Small cashout rice and chicken
Before nothing they for kitchen
Thank God i dey here today
If no be God where i for dey
Dem no believe hustle go pay
When i need help nobody dey
All does times money no dey
Shebi dem dey use me play
I dey hustle i dey pray
Make i blow like dangote
"""'
Suffer no be small
Poverty been dey use me pass time
Make i enter betking visual collect my last dime
Anyhow e be i know say one day man go still shine
Dey call you big 9
But na who get money na e dey make guyne
Na one room and parlor rent money na mumsi dey pay
For my father matter i no just know weitin i go say
I suffer no be today still recover like recochett
Now i show no messi like i be barcelona coache
Tears run out for my eyes when mumsi been dey beg landlord
Abeg landlord we go soon go just give us one month
Oh dear God comot us for shame abeg try help us
Everyday i dey pray but e be like say you wear airpod
Weitin me i don see for this life me i no fit talk am
Cause if i talk am even devil sef the thing go shock am
Act like a moving train because nobody go fit stop am
You no get you dey chase woman abeg padi help me pump am
E come dey like say na only us wey dey suffer pass
Every morning salt and garri full am make the water pass
School close TP no dey under sun i dey walka fast
UST na me and music i no even enter class
Bad boy from Port Harcourt n*ggaz know me for the street
Any music wey i drop dem just dey put am for repeat
Black and black wen i dey flow because I always kill the beat
Now dem don dey show me love before them do me like sh*t